The Nigerian guy wey they dey call Samuel Udoetuk Wills wey police catch for Takoradi say he kidnapp one young girl come appear before court today.
Weytin do am as he appear for court today no be small tin. The kidnapped girl en Mama rush to am dey ask for en pikin as he enter the judgement box. As the Mama approache am from front, the Papa too approach from the back give am dirty slap from back.
The court room wey for accomodate like 60 people come full up like stadium. Udoetuk en matter come spoil as the judge hear the case finish wey he for comot go enter the koti ride wey bring. Ebe this moment wey the Takoradi people come rush the kidnapper give am proper beatings.
Police try stop the people but they no fit. The people touch touch am small before he fi run go enter the koti ride wey carry am come court. He run lef en sandals sef for the court room.
The judge adjourn the case to April 4th


