They arrest former Liberia president en pikin say he go print money.

Fila wey we dey receive from Liberia be say they arrest former president Ellen Jonson Sirleaf en son Michael Sirleaf sake of he print dollars wey he take swerve the government.

The tin be say na Michael Sirleaf be big man for Liberia dema central bank the time en old girl be president for Liberia. Ebe that time wey they say the guy do the operation. Them say the money wey he print den swerve dey around £73milla.

Enobe only en dem arrest, he get some other two big men for the bank there wey en den them ron the move so as we dey talk now, koti for Liberia barb them too.

Right now the judge for the case top make them put them for the cooler inside small before they go set date wey they go start dey talk dema matter for court.

We go give you more fila on this matter as soon as we receive am.

Leave a comment