One guy for Bauchi state in inside Nigeria promise say he go drink gutter water for 10 minute if Buhari win the election.
As we all know already, Buhari come win the election last weeks wey this guy come enter gutter come fulfill en promise. He come sleep gutter inside drink gutter water well well for 10 minutes.
Just yesterday dem report say the guy die after he come sick for bele. He sh*t blood teeeee die. Doctors come mention one big disease wey they dey call Gastroentestinal bleeding say ebe en kill the guy

