Dem don jail Trump campaign manager wey do big 419 for America.

This oyibo chairman wey they dey call Paul Manafort don get 47 months sentence for jail for weytin den don use big grammar take explain wey I no understand.

Then this Manafort man be America president Donald Trump en campaign manager for election time. Them say them jail am because en hide plenty money wey en company for Ukraine get the time dey do campaign for Trump to become president.

Grammar plenty for oyibo 419 inside so we no want talk all of that grammar for this place but the matter be say this chairman do 419 so they jail am.

America people sef come vex say the jail time dem give am be too small for the big 419 this man do.

So oyibo too dey do 419?

Leave a comment