Nigerian boxer Efe Ajagba don beat somebody again for America.

You remember the Nigerian boxer wey one American boxer run from am before they go start de match? This guy just dey beat people for America.

Yesterday he get one match against another boxer wey they dey call Amir Mansoor. Ajagba beat this guy like en pikin.

He knock down two times for round one wey he come beat am well well for round 2. The Amir guy come give up as they want start round 3. En say eno want die so he no go fight again.

Just spie the video

Leave a comment