Sergio Ramos say he go leave Madrid if Jose Mourinho come back.

Just last week we report say Real Madrid president Florentino Perez dey talk to Mourinho make he return come coach Madrid as their current coach no dey perform well.

Now Sergio Ramos wey be captain for Madrid dey talk say if Mourinho dey return then he go leave the club.

Sergio Ramos and Mourinho never get good relationship the first time Mourinho come coach Madrid from 2010 to 2013. Wahala always dey between them.

Enobe Ramos alone no gree say Mourinho go come back, Benzema, Bale and Marcelo dem all no gree but their president say he no go listen weytin them dey talk. He go do weytin en want do.

Leave a comment