
One sad matter happen for New Zealand wey nobody dey understand. One couple wey they dey call Shana Neil wey be the father and Lacey Te Whetu wey be the mother of one baby do weytin correct human being no dey do.
Police dey struggle to find out weytin happen to this baby. These two people say them forget their baby for car inside wey they lock the car for one city wey they dey call Ruatoki wey dey New Zealand.
These people say they forget their pikin for car go smoke igbo a.k.a wee a.k.a ganja. As they smoke finish wey sleep come carry them. The man come wake up later go find en baby for the car inside wey the baby do like he die but as he come call en wife wey they come test the baby, the come see say the baby dey breath small small.
They come carry the baby enter room wey sleep come carry them again. They come sleep again for 3 hours before they come wake up. As they wake up before they see say the baby no dey breath again. Na en they come call police.
But the matter wey the police too come talk as they come carry the dead baby be say, they see plenty marks for the baby en body like somebody beat the baby wey e suffer ram well well before the baby come die.
As we dey talk so, they no fi find weytin happen to the baby since this matter happen inside 2015.
