
One Ghana footballer wey them dey call Ben Acheampong get three years sentence for Egypt sake of he fail to pay en commision of $23,000 to en agent as e help am move to Zamalek for Egypt.
The Ben Acheampong guy sef no dey play for the Egypt there again sake of he move go another club for Qatar, so as we dey talk, the people for Egypt send letters to dema embassy for Qatar make dem go serve the guy en sentence for the Qatar there.
We no know wether they go fi go bring the guy to Egypt make he come serve the sentence or what. This one ebe the lawyers they go fi explain but we go update wanna readers as the matter dey go on.
