
Roman Abramovich as we all know buy Chelsea in 2003. Since he buy the team, he transform the team wey the team win plenty trophies.
Since that time too they dey feature for champions league constantly but this year the club dey struggle paaa.
They no renew Abramovich en UK visa give am this year so he dey Russia dey manage the club from there.
The UK authorities too no agree say he go build new stadium for the club wey dem also put transfer ban on Chelsea.
Ebe like these things all make Abramovich lose interest in the club wey reports for UK be say he dey want sell the club for £2.5 billion.
The report too be say the richest man for UK wey they dey call Sir Jim Ratcliffe dey want buy the club.
Sir Jim Ratcliffe be Chelsea fan.

Wether Abramovich go sell the club or not ebe time go tell.
