Ghana police go start dey use body camera by May.

These days, Ghana police den the public no dey gree kraaa. Small time noor you go hear say police den civilians dey beef.

Just last week some video of some trotro driver den en mate wey they dey beat some police guy go viral. Before that one, dem report say some koti guy beat some journalists sake of they question say he jump red light for traffic.

Plenty of these cases between koti people den civilians dey but the victims no dey receive justice most of the time sake of they no dey find evidence.

Now Ghana police want make their officers wear small cameras on their uniforms wey go record everything they go do if them dey on duty.

DCOP Alex Amponsah-Asiamah tell Daily Graphic say them order the cameras already wey they dey expect say they go get them by middle of April.

He also talk say dem dey do this thing so say the public go get confidence in the police.

Leave a comment