
One woman and one guy go steal baby for Takoradi market wey near the Takoradi post office last Friday.
The woman wey steal the baby go one trader en there for the market wey she do like she dey play with the trader en baby. As the trader make busy small dey sell noor wey the woman run away with en baby but the CCTV camera for one bank wey dey near the market capture the baby thief en face.
The camera wey capture the woman show say the woman be short den fair so the police for Takoradi start dey find am wey dem catch am yesterday.
Them catch am with the guy wey e help am nu wey the guy dey wear Chelsea Jersey so people dey talk say he be Chelsea supporter.

Dem collect the baby from them wey they take dem go court this afternoon.


