
The dancehall king Shatta Wale say he no go just fly go Jamaica sake of he want take pictures with big stars for there.
He say he get serious link ups for Jamaica wey if he dey go there then ebe serious business he dey go do.
He say he want buy mansion sef for Jamaica den cruise G Wagon for there.
He talk these tins as King Lagazee interview am on Yaad Settings for Hitz FM .
Shatta say
We are stepping in hard. It is not by taking pictures and moving here and there, meeting people…I can fly to Jamaica anytime I want, but I can’t just move to Jamaica just to go take pictures…
I want to buy a mansion in Jamaica, cruise a G-Wagon in Jamaica, move to every club in Jamaica and make things happen in Jamaica…

