Jamaican media person say ebe Shatta Wale dem know and not the other people wey dey come take pictures for Jamaica.

The music industry make interesting since Stonebwoy travel go Jamaica like last week dey try do some collaborations with some international dancehall artists for there.

Shatta Wale come out come talk say Stonebwoy just go there dey take pictures with stars. This tin Shatta talk no sweet some Bhimnatives so them come inside for Shatta.

Now the debate be say who en songs dey play for Jamaica.

One Jamaican media personality wey they dey call Kim A Siv Dem come out come talk say Shatta be well known in Jamaica than Stonebwoy.

This be what she post for en Facebook

We go fi talk say what this lady post be bias sake of she be Shatta en Caribbean rep.

Leave a comment