Billionaire die for hospital as he dey enlarge en penis.

One rich man wey get small penis come vex say en girlfriends dey enjoy en money for free as he no dey fi suffer dem for bedroom.

As e dey so, this man wey they dey call Ehud Arye Laniado come go hospital for Paris say make doctors do surgery take increase en penis for ram.

The part of the matter wey I no understand be say this man chop 65 years. How 65 years old man go come dey go for brokos enlargement? Nawa ooo! You no go dey house watch your grandchildren?

Well the long and short of de matter be say, the man come get heart attack come die as doctors dey perform the surgery for ram inside Paris

Make he don dey rest well ooo

Leave a comment