
John Obi Mikel wey be former Chelsea player and Super Eagles captain dey talk truth wey plenty footballers dey fear to talk.
He warn young people wey play football say make dem no follow money go China sake of their league no proper for young people. He say if you don play football finish come dey hold walking stick then you go fi go China go play for there.
As Obi leave Chelsea he come go China go play but come run back to England like en back pass. Now he say make young players no go China.
The question be say if you Mama and Papa dey hungry for Africa wey they give you $2million to go China as a young player, you no go go?
