
This sickness na evil sickness. Ebe tumor wey dey fi grow for human being inside.
As edey grow, ego come dey form ear, hair, nose, teeth and even penis and vagina. You don dey surprise abi?
This tumor go fi form all de parts wey our body get as human being. Doctors say ego fi grow inside woman ovaries den man balls. Na en they dey use grammar call am Ovarian teratoma den Testicular teratoma.
Them say enobe common sickness but ego fi do pikin, mama and papa and everybody wey ebe operation they go fi take remove am.
